Melinda lyrics ..... By Emluv.




 
(Intro)
EM’LUV
Yeah
 
(Chorus)
Too many girls but you I want choose
If you choose me I swear you no go loose
Just gimme a chance I no go try misuse
Cause when am down your name I wan dey call
       (I wan dey call)
Melinda eh Melinda eh ×3
   (cause e don tey me I dey gbadu you)
Melinda eh Melinda eh
     (E don tey me I dey gbadu you girl)
 
Verse 1
Excuse me pretty girl make we try relate
I don tire to dey pause me I don dey wait
You be like wetin God dey use 7 days create
For your matter I fit die I nor go hesitate
You too fine, you and other girl dem no be mate
E be you way I choose there is no debate
Just a portion of your love I go appreciate
And any time wey you call I nor go pik am late
If you give me the chance I nor go use u play
Na fine things I wan dey buy you everyday
Follow you go your church even kneel down pray
Cause e be god wey fit make you to come my way
You be the first wey my mama really want to stay
Just dey pray make one day this this maga pay
Take you where you wanna go, anything you say
You bring the light your last name should be Faraday
Cause I’ve never seen a girl wey dey shine so bright
When you step e be like nepa just dey bring the light
We go ball we go dance we go feel alright
When we fly e go be in a first class flight
If dem fast we go slow like codeine and sprite
Every night gimme right to dey hold u tight
I no go lie baby girl you blow my mind
I feel good anytime wey you come around
 

(Chorus)
Too many girls but you I want choose
If you choose me I swear you no go loose
Just give me a chance I no go try misuse
Cause when am down your name I wan dey call
       (I wan dey call)
Melinda eh Melinda eh ×3
   (cause e don tey me I dey gbadu you)
Melinda eh Melinda eh
     (E don tey me I dey gbadu you girl)

Verse 2
Other girls nor be threat forget Fatima
And I nor get anything to do with Tina
As you don be my own no more palava
I’ll take you down to Spain, you like Malaga???
Very soon me I know say I go hammer
Day break, head burst everywhere scatter
Many meat everyday go be sallah
And any man wey cross me I go slaughter
Fine face, nice shape plus your fine fine clothes
     (Melinda eh)
But you tell other guys make them no come close
     (Melinda eh)
Cause with you by my side life go get purpose
Many pest for your list all of dem dey toast
But na me way you text make I come your coast
Even Monday your neighbor e don dey pose
On Monday na my pishaw you still dey pose
If we kiss leave Dan make e go dey tell
I no get that time I wan be dangote
E go sup very soon, see e no go tey
30 B for aza like Adeleke
I go dey till the end of I no go decale
Be the one for your zero, I no go coupe
I get vibe I get love body dey kampe
        (Melinda eh)
Me and you perfect team something like juve.
 

(chorus)
Too many girls but you I want choose
If you choose me I swear you no go loose
Just give me a chance I no go try misuse
Cause when am down your name I wan dey call
       (I wan dey call)
Melinda eh Melinda eh ×3
   (cause e don tey me I dey gbadu you)
Melinda eh Melinda eh
     (E don tey me I dey gbadu you girl)
Lyrics by okopolygistv….

Post a Comment

0 Comments